Media pipo wey sabi well well don join de committee wey dey protect journalist dem for deir award to celebrate press freedom every year even for all de catah-catah wey dey happen everywhere for de world.

Meryl Streep wey be actor go decorate de lawyer Amal Clooney with CPJ own Gwen Ifill Press Freedom Award

De Award ceremony go show online for NBC, CBS and even ABC for November 19 for Eastern Time by 8 o’clock in de evening.

For New York, on Oct 27, 2020— To celebrate de Ogbonge mind wey press pipo get; de Committee wey dey Protect Journalists go award four journalists dem from Bangladesh, Iran, Nigeria and Russia wey dem been don arrest or wey dem don charge go court because of de work wey dem dey do. De International Press Freedom Awards for 2020 dey spotlight de dedication wey de organization get to fight for press freedom everywhere for all de world.

Amal Clooney wey be lawyer and wey dey fight for pipo right; well well go collect de 2020 Gwen Ifill Press Freedom Award, wen Meryl Streep wey be actor, person wey dey openly support press freedom well-well, go present.  De event for internet go show de work wey dis year pipo, wey wan collect de awards dem don do for different documentary videos wey dem stream for plenty news network.

Streep talk say; “For dose times wey nobody know wetin fit happen, na jounalist dem dey comot go gather information wey be facts and na dem dey try so that everything go make sense for us. As dem dey ask de hard questions, and dem dey try pursue de truth no matter wetin e fit cost dem, dem be essential workers – wey dey serve public and protect democracy. Na why I dey very proud say I be part of de international press freedom award wey dem dey do dis year, and na why I go continue to dey support de important work wey de Committee wey dey Protect Journalists dey do.”

Lester Holt; reporter wey dey work for NBC Nightly News na him go host de ceremony this year, wey dem go show for internet for dis address www.ipfa2020.org plus including big news stations like NBC News, CBS News, and ABC News for November 19 for Eastern Time by 8 o’clock in de evening.

To show say all of dem dey together for de industry; other big journalists dem, like CNN chief international news host Christiane Amanpour, person wey dey host “Face de Nation” for CBS News; Margaret Brennan, PBS reporter for White House Yamiche Alcindor, and person wey dey host “World News Tonight” for ABC news; David Muir and plenty others go join Holt.  De show go join calls to support press freedom from leaders wey dey inside de journalism industry and de ones wey dey outside de industry plus; Rosamund Pike wey be actor, Samantha Bee wey dey use joke take talk news, Ronan Farrow wey be journalist, and Meher Tatna wey be former Hollywood Foreign Press Association President.

CPJ go celebrate four pipo wey dey collect de award:

·       Journalist wey dey snap picture for Bangladesh wey dem know well-well Shahidul Alam, wey dem put for prison wen he dey cover protest for 2017;

·       De freelance reporter for Iran Mohamed Mosaed wey dem just sentence go prison for more dan four years and wey dem ban from him journalism work;

·       Dapo Olorunyomi,  wey follow be owner, CEO, and wey dey publish de Nigerian newspaper Premium Times, and wey don tey since him follow dey fight for press freedom; and

·       Svetlana Prokopyeva, wey be reporter for Radio Free Europe/Radio Liberty wey dey for Russia wey dem convict her say she dey always “support terrorism” because of talk wey she talk for one radio show..

“The pandemic don bring plenty problem wey journalist never see before, everywhere for de world, but we dey happy say we fit get small time to gather together to take celebrate de strong mind of dis pipo. De pipo wey dey collect our award dem, na example of de kind of commitment wey many pipo wey dey fight against blockade make dem bring us news get, and dis pipo dey inspire me. Na so Joel Simon, executive director for CPJ take talk am. “Even though to dey show the event for internet na new thing for us, we dey happy well-well because of de chances to take talk de story wey dis method dey give us.”

Every year dem dey give de CPJ Gwen Ifill Award for Press Freedom to pipo wey don show big-big achievement for press freedom matter. Dis year de pipo wey dem go give de award; Amal Clooney, don dey support de rights of journalist tey tey and she dey tell leaders for everywhere to support press pipo. She don work as lawyer for plenty journalist wey dem dey put fear for them body and now she be lawyer for reporter and editor wey dem know well-well– Maria Ressa  wey collect de 2018 Gwen Ifill Award — . Dem don charge Ressa to court for her country wey be Philippines because she dey report about de corruption wey dey government for her news organization wey dem dey call Rappler. She go interview Clooney for part of de ceremony.

The chair person for dis year event na Patrick Gaspard; na him be de president of Open Society Foundations. If you want more information for de gala event wey go show for internet, you fit call Buckley Hall Events for (914) 579-1000 or CPJ development office for(212) 300-9021, you fit send dem email for [email protected].

Media pipo wey wan arrange interview with de pipo wey dey collect award or de sabi pipo for CPJ, dem fit send email go [email protected].

# # #

About de Committee wey dey Protect Journalists

De Committee wey dey Protect Journalists na independent organization wey no dey make profit and e dey promote press freedom everywhere for de world. We dey fight for de right of journalist make dem fit report news safely without any kind of fear at all.