CPJ advise for safety: How to report de Coronavirus disease

Journalists for Mexico wey wear Equipment for Personal Protection because of COVID-19 disease to report protest wey workers for General Balbuena Hospital dey do for inside Mexico city on April 16, 2020 (AFP/Pedro Pardo)

              We update am for August 14, 2020

World Health Organization (WHO); de join-body of sabi pipo wey dey torchlight all de health mater for dis world don declare say COVID-19 (novel coronavirus) disease na world-wide pandemic. Na him be say de disease dey nearly everywhere for dis world. WHO talk dis tin on March 11, 2020.

Journalists dem, everywhere for dis world dey do better work to give pipo de informate wey dem need to know about everything wen dey happen with dis virus and wetin govment dey do to fight de virus, despite de plenty bad bad tins wey govment for different kontris dey do to reduce independent reports them, and how to get de informate for de reports as CPJ don write down. Media pipo dey face plenty plenty hardship and stress wen fit make dem dey exposed to sickness as dem dey travel to go interview pipo and because of de kind place wey dem dey work sometimes as CPJ take gather for interviews with journalists. Journalists dem don face censorship, detention, face-to-face harassment, even online harassment join; dem don loose deir work because of dis Corona disease,  as CPJ take report am recently.

As de mater dey continu and fresh informate dey commot; de sabi pipo wey dey handle health mater go dey bring new advice and fresh news wey concern de virus. For journalist dem wey wan know de latest advise wey sabi pipo for health mater dey give, including de blockade wey fit  affect dia work; make dem follow informate from de WHO and other public health pipo wey dey around dem for dia kontri.

To stay ontop de informate as de latest torry for dis mater dey break, de Johns Hopkins University Coronavirus Resource Center go help wit correct news wey persin fit trust

HOW TO STAY SAFE WEN YOU DEY WORK FOR OUTSIDE

Blockade still dey untop travel wey dey cross one kontri enter another kontri, and this blockade dey change all de time. All de assignments fit easily change or dem fit cancel am; wit chikini informate or even without any informate, because of de sharp-sharp way wen tins take dey change and new tins dey happen everywhere for de world.

Pipo wey wan report about dis COVID-19  disease make dem reason dis informate wey fit kip dem safe:

Before-Assignment

●To reduce de chance wey dis virus fit take catch persin and if e possible, make pipo still dey do interview wit phone and ontop internet, instead of face-to-face.

● Wen dem dey select workers wey go report about dis COVID-19 disease, management suppose put for mind say sometimes some pipo dey attack other pipo from some kontris because of de color of dia skin; wey oyibo dey call-racism,  na so NHK World take highlight am

●  Some kontris wey been dey reduce deir lockdown don put de lockdown back again na so Forbes take report am. So make Journalists talk wit dia management make dem know de kind plan wey de management get for dem, if dem begin sick as dem dey work; dem suppose consider say dem fit need to separate demselves from other pipo and/or dem fit dey locked up for one place tay. Na dat kind tin oyibo dey call quarantine.

How to make sure say you and your pipo no think too much come sick

● De family members of pipo wey dey report COVID-19 fit come dey worry well well about dia persin. E go good make you talk wit dem about de problem wey fit happen and about dia worry. You fit even arrange for your family members to talk wit de pipo wey sabi health mater for your office.

● Correct informate for media pipo wey dey cover dis kind hard situation dey de DART Center for Journalism and Trauma Make you check CPJ emercy page for safety materials wey come from outside: professional guidelines to help journalists wey dey report COVID-19 manage their level of thinking join

How to avoid make you no infect yourself and make you no infect other pipo

Plenty-Plenty kontris dey practise social/physical distancing, even though de way weh dem take dey do de social distancing fit no be de same for different kontris weh you fit dey as dem talk am for Reuters. If una dey report about places wey get emergency services, or una wan visit place weh get big-big risk; make una find out well well about de steps wey dem dey use to take stay clean.

If una no sure about dis steps, make una no go der.

De Ogbonge steps wey sabi pipo dem recommend to avoid dis sickness na dem be dis:

● Make you continue dey observe de social distance weh dem suggest with everybody; dis social distance fit dey different according to de way wen de govment dem for dat area take advice. You suppose dey very careful wen you dey near pipo wey dey show say dem fit get de sickness wey cold dey cause, like cough and sneeze, wen you dey interview pipo wey don old, pipo wey get sickness for body, anybody wey dey close to pipo wey show say dem dey sick, pipo wey dey walk for hospitals wey dem dey treat corona patients, or pipo wey dey work for place wey get big big risk.

● Make sure say you wash your hands all de time and wash am well well for at least 20 seconds at once, wit hot water and soap. Make sure say you dry your hands as you suppose dry am. Very important steps wey fit help you wash your hand and dry am well well dey for WHO website

Make you use gel wey get anti-bacterial or wipes if hot water and soap no dey, but as soon as e possible, still wash your hand wit soap and hot water. (CDC recommend say make pipo dey use hand sanitizer; wey get alcohol inside wit more than 60% of chemical wey dem call ethanol or 70% of chemical wey dem call isopropanol to clean dia hand.) Make sure say you no replace regular washing of your hand wit de work wey dis hand sanitizer or hand cleaner dey do.

● Cover your mouth and nose anytime wen you dey sneeze or cough. If you use tissue cover mouth or nose wen you dey cough or sneeze, make you throw-way de tissue immediately for de right place wey dey safe. And no forget to wash your hand after you finish.

● Try no dey touch your face, nose, mouth, ears, and other places as dem talk am for de BBC

● Make you no drink or eat from cup, plate or spoon and fork wey other pipo don touch or use.

● Remove any jewellery and wrist-watch wey you wear before you start work, because de virus fit dey ontop different types of surface for different periods of time.

● If you dey wear eye-glass, try clean am gently from time to time wit hot water and soap.

● Make you think well before you choose clot wey you go wear because some clothes easy to wash pass others. You suppose remove de clothes weh you wear small-small and den wash am inside hot water and plenty detergent after de work.

●Reason as you go take go work, come back; which kind transport you go use. No enter motto for public, wen pipo dey rush and make you use sanitizer wey get alcohol inside take clean your hand wen you come down from de motto.

● Make you pause, take break from time-to-time make you for no lose strength; because persin wey don tire fit make mistake wit de steps wey e suppose take to stay clean. Remember say persin fit need to drive far before and after dem finish dia work.

Make sure say you wash your hands well well, wit hot water and soap all de time, before you enter area wey de virus dey, as you dey de area and after you leave de area wey de virus dey. 

● If you notice say you dey get signs of de sickness like fever or e dey hard you to breath; reason as you go take get treatment. Plenty pipo wey dey work wit govment ontop health mater don suggest say e better pass, for persin wey get de sign to lock himself for house, so dat e no go spread de sickness give others. If you dey for place where pipo wey get dis virus plenty, e possible say you fit meet other pipo wey get COVID-19 for health centre wey sick pipo plenty and dat wan mean say you sef fit catch de sickness easily.

● Make sure say na only cooked meat and egg you dey eat.

How to prevent infection from things wey you dey take work

● Make sure say na microphone wey get long hand like ‘fishpole’ na him you dey use, and use am from place wey far enough to dey safe. De only time wey you fit use clip microphone na wen dem don already control de circumstance well-well and wen you follow all de plenty hygiene rules weh dey ground.

●Make you wash de cover of your microphone with hot water and use chemical remove any virus wey fit dey am after you finish any assignment. Find who fit guide or teach you to remove de cover safely, make you for fit avoid cross contamination. Make sure say you no use de type of cover wey dem call “wind muff” if you fit, because e hard to clean.

● Make you decontaminate de equipment all de time, wit wipe wey get sharp-sharp chemical wey dem call antimicrobial wipes. Example of dat kind of wipe na Meliseptol, after which you go do proper cleaning, plus wit phones, tablets, leads, plugs, earphones, laptops, hard drives, cameras, press passes, lanyards and any other tin wey you dey take work.

● Make sure say you decontaminate or you remove contamination from de equipment again wen you dey put am back for hin house and those wey suppose take care of de equipment know on time and dem don learn how to safely clean de equipment. Make sure say dem no just dump any of de equipment carelessly come leave am, wen dem never hand am over to de person wey suppose take care of am. 

(Note: I adjust this whole sentence because of the use of the word deep)

● If na motto you dey use waka, make sure say dem clean inside de motto well well after you finish any assignment. Na persin wey dem don train well-well suppose clean de inside of motto. Dem suppose focus more on de motto door, steering wheel, geer stick, hand break lever, wing mirrors, head rests, seat belts, dashboard, and window winders/catches/buttons.

How to clean your electrical equipment

follow dis steps to give yourself all de guidance wey you go need in case you dey clean electrical equipment. Make sure say you read de steps from de producers of de equipment to guide you before you try start dey clean any of dem.

Some more steps to guide you dey dis write up

Equipment for Personal Protection (EPP) wey medical or health pipo dey use.

To dey safely wear (donning) and to dey safely remove (doffing) and medical EPP  (like gloves weh you fit throw-way, face masks, aprons weh fit protect you/overalls/bodysuits, and even shoe covers wey you fit throw-way among other tins) require say make you follow de strick observance and adherence to de best safety practices weh dey. I beg click here for general guidiance from de CDC. Make you take special care wen you dey remove (doffing) EPP as na this time de risk for cross-contamination dey high well well. So make you no play with dis measures at-all at-all. If you dey doubt anything, make you ask experts dem for guidance and training before you go for any assignment.

Put am for mind say for some kontris medical EPP no dey plenty for market, and e even dey hard to find am buy. so if you come join those wey dey use am, to get am for market fit hard. 

● Make you use protective hand-gloves if you wan visit or you dey work for place wey de infection dey like hospital or health centre. Notice say Nitrile gloves dey protect pass latex. To wear two pairs go increase your safety.

Face Masks

The correct way to dey use face mask dey very important especially for journalist wey still dey report for community; this one fit come mean say dem go dey go places wey no dey open too, places wey people plenty and dem go dey talk to people for outside. For July 9, 2020, WHO been give advice weh dem update say COVID 19 fit dey travel for air for some kind places. Some of dis places na (and other places fit join) place wey no dey open, place wey get small air or place wey  air no dey pass at all and where people plenty. Make you put am for mind say de virus for dis places go really plenty pass de way e go dey for normal places; dis one go come increase de chance say you sef fit catch de virus.

Many kontris now don dey require say and/or advice say make de general public dey use something cover  deir face and/or wear face mask  as Al-Jazeera take report am. The CDC recommend say make pipo wear  plenty-layer-of- cloth take cover faceInstead of de medical grade mask wey no too dey market– to take cover their nose and mouth  wen dem dey for community.  WHO advise say pipo wey don reach 60 years or wey pass 60 years and pipo wey get some kind sickness for body suppose wear medical grade mask  wen dem dey outside and dem no fit do physical distancing. Dem advise say make all de other pipo wear  mask wey get three-layer fabric.

Unless e be say who use mask use am well, de possibility say mask fit join cause de infection don worry pipo. One new research wey Lancet do show say de quantity of de virus wey plenty reach level wey dem fit notice still dey for mask wey dem dey use for operation, seven days after de mask touch de virus. Sake of dis study, to remove your mask, use am again or touch your face wen you wear de mask fit mean say your chance of catching de infection don increase. 

If e be say you wear mask make you follow dis advise. 

● Put am for mind say face mask fit no dey market, and/or de price fit increase sharply, based on de area.

Internet Security

● Put am for mind say journalist fit experience more attack for internet, sake of dia report about COVID-19 mater. Check CPJ professional steps   to take protect yourself from attack

● Govments and technology companies dey use more ways to take check and track how de COVID-19 dey spread. de NSO Group, wey create  Pegasus, join dem. Dis Pegasus na something for internet wey oyibo call, spyware.  Dem don use am target journalists, as Citizen Lab talk am. Groups wey dia work na ontop civil liberties don dey worry about how dem fit use dis surveillance techniques take catch pipo after COVID-19 finish. Even Transparency International don dey follow dis mater for dia website

● Make you pause think, first before you click links or before you download any document wey carry informate about COVID-19. Thieves don dey take advantage of de health problem and fear to take target pipo and organisations wit different types of plenty phishing attacks wey fit cause make malware enter your system as Electronic Frontier Foundation  talk am.

●Take note of  bad apps wey dem dey take target pipo for ransomware, like COVID-19 Tracker

● Dem don report say maps wey dey show latest informate about COVID-19 mater from correct sources like WHO, fit get malware wey dem fit take steal passwords

●Dey careful about some wrong informate wey govment sponsor as dem don report for The Guardian, wit de wrong informate wey dey other places. WHO don give special warning about dis tins and BBC sef don talk am.  For WHO website you go get myth buster guide wey you fit take check all dis tins.

● Dey careful about informate ontop COVID-19 wey dem share as massages for apps wey fit contain fake news and tricks to deceive you.

● Make you notice say dem don dey moderate COVID-19 write up for Facebook wit artificial intelligence (AI) instead of human beings we dey check dat kind write-up. Dis one don cause make dem remove correct write up about de disease by mistake 

Make you read about conferences and privacy issues ontop internet so dat you go know wetin dis services dey do wit informate wey dem collect about you; de level of dat informate wey dem fit collect and de level of security wey dem get. Notice say as de number of pipo wey dey work from dia houses dey increase, hackers don target services.  

● Make you dey alert about de problems wey fit come if you dey report on/or from kontris wey get authoritarian govments, wey fit dey monitor as de report about COVID-19 dey waka. Some govment fit wan hide de level wey de sickness don reach and/or suppress media pipo, as CPJ take talk am

How to physically secure yourself from criminals wen you dey assignment

Journalists and pipo wey dey work for media suppose put for mind say de level of dislike and attack against dem dey increase, even harassment wit mouth and physical attack still dey happen where de journalists dey work as e take happen recently for U.S. as the U.S Press Freedom Tracker —Germany, the U.K., India, and Somalia take talk am

The economic situation for all de world  still dey hard well-well  as pipo still dey loose dia job and up to half billion people don dey enter poverty, as Oxfam take talk am, de possibility say  crime go dey increase well-well  dey very sure especially online crime  as de research from the University of Cambridge take talk am.

 

● If you dey report from prison or place wey dem dey hold pipo, journalists dem suppose dey alert about de kind danger wey fit come from inmates wey dey protest and/or de riot wey fit happen ontop dis COVID-19 sickness, as e been take happen for Sierra Leone, Italy, Nigeria, Colombia, and India

●Put am for your mind say crimes fit increase dis period and notice say kontris like Iraq U.S. A, IrelandIndonesia, Ethiopia, Palestine, Somaliland and Iran don release some prisoners to create space for prison dis period of COVID-19 outbreak. 

Travel wey dey cross one kontri to another for Assignments

Because of de world-wide blockade wey dem don put for traveling, to travel from one kontri enter another kontri  still dey very hard. If you fit travel go abroad for your assignment, you suppose reason dis steps:

● Make sure say all de necessary vaccines and tins wen you fit take prevent de disease for where you dey go dey up-to-date and on time. Reason how to get de flu vaccine so dat you fit avoid possible confusion ontop any sign of de sickness wey you fit get. 

● Make you check de insurance plan wey you get for traveling and reason say you fit no get support for Corona virus travel. Again, put am for mind say many govment don give different types of advice about traveling, wit warning about traveling to abroad.

● Always dey check de status of any event wey you wan attend, sake of say plenty kontris  don ban gatherings for public places kpata-kpata, or any kind gathering wey pass some number of pipo

● Make you check any travel ban wey dey in place or de one wey dem wan start for de kontri wey you dey go, wey still fit change with small informate.

● No travel if you dey sick. Most of de airports wey dem dey take travel go abroad or regional airports don introduce strong plans to check health status. De fact say travellers go face testing and/or by force quarantine/self-isolation as dem land dey almost certain. 

● De choice of where to travel go around de world, dey very-very limited because  airlines dey cancel dia flights wey dey go different places. 

● Consider de tins wey you suppose buy carry follow body. Even though de cases of pipo wey dey panic dey go buy plenty tins don dey reduce, Face masks, hand sanitizers, soap, packaged food, and toilet paper still fit scarce for market, so make you still consider am. Notice say situation for kontri wey you dey go, fit come worse because of strike  and/or shortage of workers sake of de COVID-19 infections.

● Make you check de latest situation ontop visa mater for de kontri wey you dey go because plenty kontris don stop dey give visas and dem don suspend de ones wey dem been give.

● Check if de kontri wey you dey go, need medical certificate to prove say you no get COVID-19. 

● Make sure say de plan wey you dey make to travel dey flexible and allow yourself spend more time for airport, sake of de steps wey involve health screening and temperature check points. Dis same advise dey necessary for railway stations, ports/docks, even long distance bus stations too. 

● Make sure say you dey ontop any informate wey fit change for de place wey you wan follow enter de kontri, because some kontris dey only allow foreigners enter dia kontri from some kind airports and terminals.

● Continue to dey monitor sources inside your kontri, for any news about blockade wey fit affect movement inside de kontri wey you wan travel go.

After-Work

● Continue dey check your body for any signs of de sickness wey you fit notice.

● E go fit need to isolate yourself, as a matter of fact, after any assignment wey dey very risky. To understand am well-well, I beg check all de necessary advise wey govment dey give.

● Make you monitor all de latest informate ontop COVID-19 mater, wit any quarantine and isolation steps wey dey in place, both for your kontri and where you dey travel go.

● based on de level of infection wey dey de kontri where you been dey, you suppose consider say e need make you keep journal of names/contacts of pipo wey you come close to for 14 days after you return. Dis one go help dem trace all your contacts in case wey you start dey show de symptoms.  

–If you get de symptoms

● If you begin notice say you dey get de symptoms of COVID-19,  no matter as e small reach, tell your management pipo so dat dem go help you get de right motto wey go carry you from de place gon gon wey you dey finish your assignment to your house. No just enter any taxi

● Follow de advice wey WHOCDC, or any other sabi pipo ontop health mater for your kontri dey give to take protect yourself and your area.

● No comot from house for at least  7 days from de time wey your symptoms start dey show (de time fit dey different according to wetin de government talk). If you do like dat, e go help to protect other pipo for your area as you get de infection.

● Make you plan early and ask pipo for help. If you wan buy anything, ask your employer, your friends and your family to help you buy am and make dem leave de tin for front of your door.

● Follw de correct social distance from other pipo for your house anytime wen e possible. 

● Make you sleep only you, if e possible.

● If you dey live wit other pipo, you suppose isolate or separate himself from dem. One important guide wen fit to help persin  ontop dis mater dey here. persin suppose take special care when hin dey use bathroom, toilet and kitchen items, so dat hin no go infect other pipo. 

● Wash your hands every time and wash am well for at least 20 seconds, wit soap and hot water.

● As far as e possible, stay away from pipo wey de sickness fit easily catch like; old pipo and pipo wey don dey sick before.

● You no need to call de sabi pipo for health mater for your country if you wan start to isolate yourself, unless if your symptoms increase as you dey de isolation.

CPJ get online Safety Kit we dey provide journalists and dia newsrooms wit de basic safety informate ontop physical, digital, and psychological safety resources and tools, even informate wey cover civil unrest and elections join.

[Editors’ note: De first time wen dem publish dis safety advise na on February 10, 2020, and since then, dem don dey revise am from time-to-time. De date wey dey ontop now dey show wen dem last update am.]